Enter studio one time, producer was like & #39;Are you set?& #39; na so I carry higher education book come out, full of lyrics.

Producer was like & #39;You sure you are ready?& #39;, I was like & #39;hit me& #39;.

First verse, I don finish half bag of pure water. Person wey I wan feature dey look me like https://twitter.com/IamRashman/status/1325767815069118470">https://twitter.com/IamRashma...
T Shaggy wey wan feature on the song dey look me as I dey sweat for booth.

My writing come dey look tiny, Producer off beat. E say make I dey freestyle.

My Freestyle dey sweet, dem dey feel am. But to record, that day just no be my day.
We sha finish the song, Producer like am, T Shaggy like am. But I no dey feel am.

In my mind, I was like & #39;Mode 9& #39;s delivery no be like this& #39;.
Them give us the CD after 2 weeks, people for area like am, but for my mind, this thing no enter why una dey hail me?
Na so I hear one guy Abbey, the guy sabi sing. Them say dem wan do Independence Day song for Naija say dem wan feature a rapper.

T Shaggy talk say na me sabi rap pass. Omo, dem call me based on T shaggy, na me rap pass. T shaggy dey smile, for my mind I dey look T Shaggy like
Na so dem carry one guy come, Something Hammer, the guy dey rap pieces... T Shaggy still dey talk say & #39;Rashman sabi rap pass this guy& #39;

For my mind I say & #39;Tshaggy no hype me again, if na the 10k you owe me dey make you hype / wan disgrace me, abeg I no go collect am& #39;
Last last, dem no record the song sha.

So many crazy stories, T Shaggy na just good vibes. We recorded two songs after, his family liked the one I was on over the one he recorded alone.

T Shaggy had so much belief in me man. Such a great guy
I remember years later when Don Jazzy did that Enigma competition, T shaggy called me & #39;Rashman, you have to enter that competition. You go win am& #39;

Na so I enter bike go meet Booda Tiri (Another person who believed I could be a dope rapper). This bros carry me go meet producer
Everything was set, Don Jazzy& #39;s enigma beat was playing. They were waiting for me to start spazzing off the top.

Ta-da! Na so I carry higher education note book come out again. Egbon Tiri was like
Egbon Tiri just put hand for head & #39;Rasheed, shebi o sowipe oti prepare, kini gbogbo eleyi?& #39;

The producer was so honest with me, he said & #39;You have a good voice for rap, good lyrics but your delivery is awful& #39;.

I sha recorded the song but I no hear am till today. E pain Tshaggy.
You can follow @IamRashman.
Tip: mention @twtextapp on a Twitter thread with the keyword “unroll” to get a link to it.

Latest Threads Unrolled: