Well shall we
,first day they gave me freedom to drive alone,I just carry car dey cruise
,na message them send me oh,I don already do message finish,I no drop car,I Sha want make one girl like that see say me seff dey drive, na thread
https://twitter.com/SMITHIEstan/status/1321017524872425473



I reach one side where I go turn go left na him I see this woman car,I farabale
as per make she pass b4 I go pass ooh,I don feel say she don pass na him I boost,I hear small sound,I think say na just small scratch,I wave my hand up say make she no vex







The other weyrey wey no know the woman don commot key for my car I one dey form guy dey beg,na him I sight koboko ontop the woman dashboard,I fear 
,I quickly kneel down for oritameta mehn, babes dey see me dey laugh 












Dem settle everything,I find break oil, clean the spot wey I screech but the weyrey wey commot key no dey happy,he dey shout at least you go slap am nau 
weyrey slap who,God go punish your papa,I never drive since then
,
I don get PTSD since then omo



