University Students, Open this Thread.
Great Nigerian student..
Of the Greatest Nigerian student..
Hi Dear.. How you dey? I hope you are fine, if so Glory be to God.
My main purpose of organizing this Thread is to remind you of what you're getting into as school is opening nationwide from September 14th.
Firstly, your landlord no go wan hear story, so you better calculate how much remain for your house rent wey u pay.. Some of una go meet una load for outside depending on how much u give Oga landlord before you commot 5months ago.
Secondly, Lecturers go wan magically use two weeks finish their course outline of four months.. Meaning say u go need find way open your head literally, begin dey chuke the books directly inside to avoid knacking F
Thirdly, Exams no go dey funny, Matter of fact, exams dey always Hard even when we dey use full semester.. E come be now wey be say na only 2 weeks u wan use.. Exams go dey like life or death matter.
Fourthly, Carryover don pile, you suppose use this 5 months take cover up some materials but since you be Content creator.. U no gree drop ur phone..
See you.. See extra carryover
Fifthly, All the foodstuff wey u no gree dash people wey u dey always dey stingy for because you be greedy fellow, Rat don chop am finish.
Sixthly, that your fine cloth wey u leave for hanger?? Rat still don chop am.. E don turn crazy shirt.
Seventhly, to the First years wey never do Matric, u never get Matriculation number and you dey call your self university student with your jamb reg number? 😂.. Okay prepare for admissions waka waka.
Eightly, Final year students, check previous thread.
Ninetly, if your school na for south east, Rain wey dey fall since two months now dey bloody, meaning say your water don pass through ur window destroy or your Electrical Equipments, sockets, and even your foam.
Prepare for that one too.
Tently and finally, Gather money go.. U go need am.
You can follow @Nsukka_okpa.
Tip: mention @twtextapp on a Twitter thread with the keyword “unroll” to get a link to it.

Latest Threads Unrolled: