Meanwhile Everything #BBnaija is trending, I got #Thecallwithobaby UPDATES for you ere. Happy Sunday ma People! it's a beautiful day. Weeks ago on Ado-Ekiti's @Voicefm899 Obaby put on live call A phenomenal Gospel Rapper @engocbe.
STAY LOCKED.
https://twitter.com/Solohtolz/status/1292152447134248969?s=20
https://twitter.com/Obabykpankan/status/1291888652507918337?s=20
1. Many say he is the amazing Celestial Rap Sensation, some know him as a Rapper,a Musician and a VJ. Well you would never know that he was once a Sunday school teacher😃 f he didn't tell you.
Ladies n MentuGents meet @Engocbe as we dish you the LIVE convo with @Obabykpankan.
1. #Thecallwithobaby

@Obabykpankan: Ok so People know you as Engo, wetin be the real Name?

@Engocbe: Well, My name is Clement Oluwasegun Ezekiel, my Surname na Clement, so if any Woman marry me now she go be Mrs Clement.

Cc: @Voicefm899
@Obaby: she no go be Mrs Engo.😂 Ok wetin come bring the Engo come outside?

@Engocbe : Engo na based on the idea of my musical Journey, Na Entertainment Gospel so i dey joggle the good music from sacred ones and the secular ones, join am together wey we dey pass correct message.
@Obabykpankan : E mean say you over think am like tinkabell come write am wella, Ok Ma Pipu if you on this thread, We dey reason am with @Engocbe unto #Thecall make we know wetin dey happen for him pocket, wardrobe.

#Thecallwithobaby
Q: OK @Engocbe give us Small idea into your Background How e start?

Ans: My Maleh na Children of God, we dey call them Pastor that kind thing, My mother was a Methodist family, but she dey do Fashion designing, so she dey Joggle evertthing together.....

#ThecallwithObaby
.....but me i be Street boy dey enjoy myself, background wise i don know church, street and club i don know everything.

#ThecallwithObaby
@Engocbe: Education wise i study for Ekiti for UNAD now EKSU, Eyin #Ekiti mo kin yin oo! Inn Okun,😂I study Electrical Engineering, but Music just come along the line we still dey Joggle dey do everything together.

#Thecallwithobaby Cc: @Voicefm899
@Obabykpankan : So where you come from?
@Engocbe : I be Lagos boy oh, we be all this Badagry people na.

@Obabykpankan:😂All Join na, according to @DJINEE all of us be Naija. For Warri if you say "U study Elect Elect dem go say shut up you be electrician"...
#Thecallwithobaby
...So you study Elect Elect but you come dey do Music na word and opposite, so wetin sup?

@Engocbe : Well e get Technology part of ElectElect, if you dey do DigitalMarketing too na still computer package Information technology e never commot from the zone....
#ThecallwithObaby
.....you still dey engineer your speaker *Laughs* You still dey rewire.

@Voicefm899 #ThecallwithObaby
@Obabykpankan:😂Omo se lamba, see as you take link am!All Join Ok so how many Years you don dey for Music Industry?
@Engocbe: The Music thing normal,na from birth oh, Just say na choir we use start am, but the first time i enter Studio as play play that was 10 years ago in 2010,
....and the song wey i drop then still dey give me money till today! that was #OmoceleReloaded.
@Obabykpankan : Wait wait!! oh, so na #OmoCele be your first SONG?! The way u you take dey switch up for that song ehnn, wow! that song dem fit play am for anywhere dem go dance.
@Engocbe: We thank God o, Yeah na my First song be that na!
#ThecallwithObaby @Voicefm899
.....So Officially wen i get my own Musical movement na 2018, I no dey wait for anybody to come sponsor me you know how e dey be for industry na say person go help you, so officially na 2018 i start but i've been there since 2010. - @Engocbe

#ThecallwithObaby @Voicefm899
@Obabykpankan : Ok wow!😅Man say dem born you for Music, you be wan do strong head go do ElectElect but God plaiz your focus.

Ok make we enter another level, U know say Music of nowaday no be music of then,.....

#ThecallwithObaby
...So who be the people wey shape your music, who be the ppl wey for this music dem influence you.

@Engocbe: Well i go say shoutout to my Papa, as he be spiritual man reach he dey buy us all kind of music, we dey hear juju,Fuji Akpala, Hiphop, tupac and all,.....
....so as i small i hear all those songs, e don make me like different kinds of music. He dey listen to all those kind music, e don influence me already.

Cc: @Obabykpankan @Voicefm899

#ThecallwithObaby
#ThecallwithObaby
So i try blend Hiphop with African style because hiphop dey bold but as i grow e get some ppl wey i come like ,ppl like @Mi_Abaga, ppl like @VectorThaViper and i also can't take it all from Dagrin and also @phynofino him dey kill am.
...For International i like #KendrickLamar, I dey learn from the small ones and the upcoming too.

#ThecallwithObaby
Q: Any EP or album we suppose dey Expect anytime soon.

@Engocbe : Omo e dey o, Na make God epp us push am well and Big shoutout to @Obabykpankan Obaby and @Voicefm899 Voicefm dey try for us, i appreciate una too much. I get one EP its called #JECHOHIRAMI e dey all platforms,
,..... na 8 tracks dey there But my latest single i drop am for my birthday wey just pass, i feature Kennyblack, na Ologo ft @Kennyblaqmcfr you go see am for everywhere.

LISTEN HERE.


#ThecallwthObaby @Voicefm899
#TCWOFunnydrills

Q: Wetin be the food wey dey Burst your brain??
Ans: I Like Bread and beans ooo! if you come put Plantain you don finish me.

#ThecallwithObaby @Engocbe @Obabykpankan
Q: You know say many musicians get baby mama, so any baby mama for your side And any baby mama for Future?

Ans: Omo no baby mama na Mama Africa I get o, wey dey inspire me. No baby mama in future But @Obabykpankan e No easy o but we dey try do the right thing.
#ThecallwithObaby
@Obabykpankan : Ok like this like this, e get sister wey dey your life so all the single sisters wey dey look Engo make dem go look Bush?
@Engocbe : Abeg if you get hope keep the hope alive o. 😅 dem de important oo.
#Thecallwithobaby
Q: OK Ladies nd Menugents no forget na Engocentric Engo we still de reason, you don hear say him Latest EP dey out #JECHOHIRAMI God of Blessings.
So give us 5 Artist wey you go fit reason with.

@engocbe : I love @burnaboy dey deep, ....
....then i go like work wih #Kendricklamar also mk he school me o, then i no mind work with Oga Ginger, cos my own kind of music i like make e touch everybody irrespective of tribe, religion and all.

#Thecallwithobaby @Obabykpankan
....Then if i get the opportunity to work with @sinach sef e no bad, Den i go like work with @Drake.

@Obabykpankan : You no mention any Female person oh, na wetin dem dey call Gender Inequality oh!, dem ladies go dey protest now.😂
@Engocbe: Ah abeg e get one person for Africa wey i go like work with, Na @angeliquekidjo , she be woman, she be Mama, as in the vibe is different.

#Thecallwithobaby @Voicefm899
@Obabykpankan : OK! No time to check time Ladies and Mentugents na here we go like match break, As you dey you na senior man already, you face challenges we for like hear your story but time no dey so use your story taKe advise person wey dey start career.
#Thecallwithobaby
@Engocbe: I go just say from my own experience, Talent i not enough oh, everybody get talent o, or you go sleep there.if you don't know now independent talent na the future Everyday dem dey create talent, identify yourself, get copyrighted, be independent,....
....put your songs on all platforms e be like football na, if you play football small na later dem fit sign you.

CC: @Obabykpankan @Voicefm899
#TachaTitansCruise
OK its a beautiful Tuesday dropping Update LIKE its Hot, Last Update we had the Engocentric @Engocbe, a very talented n Spontaneous Rapper on #TheCall.
Nice having you Mr ENGO.

Now we go drop UPDATE with @alama_ymzn also a Rap Artist. https://twitter.com/Obabykpankan/status/1294405551502299152?s=20
Don't forget its #TheCALL with @Obabykpankan on @Voicefm899.

We track and hijack your favorite Celebrities and upcoming Talented Nigerian Acts and Put them LIVE on air via Phone Call. Every Saturday by 4:30 - 5:00.
Just Tag your Fav Celeb and we do the rest.
#ThecallwithObaby
#ThecallwithObaby
📞📞 * Calling* @alama_ymzn
@Obabykpankan: Hello, My brother Wetin dey sup

@alama_ymzn: How far na!, Can you hear me, i can hear you.

@Obabykpankan: : hmm This one wey u dey speak English😂
@alama_ymzn : I just dey Overwhelmed Mehn, the Joy just too much.
@Obabykpankan : Ok Ladies & Mentugents if you dey read this thread This na @Voicefm899 ,Like this na #TheCallWithObaby we dey, and we dey reason Arewa Kastina Finest, dem dey call this youngman @alama_ymzn . Greet your pipu for AdoEkiti.

#TheCallWithObaby
#TheCallwithobaby

@alama_ymzn : #Adoekiti Pipu, I greet una o, I swear i'm so i loyal, as una show me love for here, all the way from KT.

@Obaby: I greet u, you don ready for us like this, we wan enter your Cupboard, kitchen like this. so Tell us Wetin be your name.
#Thecall
You can follow @Solohtolz.
Tip: mention @twtextapp on a Twitter thread with the keyword “unroll” to get a link to it.

Latest Threads Unrolled: