Good morning Twitter NG.
You no com online this weekend?
Oya take summary #Okpayarns
1. Chronicles of Tife and Sansa season 1 and 2 don drop for Netflix, as dem don involve Parents, Email scandals, and Segalink for this episode. Season 3 to be release this week.
2. Anonymous hackers come out to tidy America untop George Floyd Vengence, as dem don dey drop Donald Trump and other celebrities record wey dem hide for under carpet.
3. Nigerians begin beg them to come hack our own Gov't like say our Gov't dey hide anything for our back. The only anonymous for Nigeria na twitter "Anon".
4. We demand Justice as Uwa a student of Uniben go read for inside RCCG na him dem rape her still kill her inside Church.
5. We dey wait RCCG to give report on the case as na for inside their church e happen, dem this one jus lookaway begin upload thier online tithes offering digit.
6. Dem begin dey pray for Daddy G.O because some of their members say na devil wan begin scatter thier church
7. WE NEVER TALK THAT MATTER FINISH, 11 MEN DON RAPE ANOTHER 12 YEARS OLD GIRL FOR ZAMFARA. AS EVERYBODY DEY PROTEST TODAY, FROM YOUR OFFICE, IN THE STREETS, IN PUBLIC ROADS, FROM UR HOUSE, HOLD A PLACARD AND DEMAND JUSTICE!
8. 8. Some celebrities chuke mouth for the matter, as Falz say make we enter protest as this matter get as e be.
9. For where we dey talk protest some people get mind, like swallow hot yam begin dey follow God dey wear one trousers.
10. Dem don begin drag God, As Angel Micheal sitdown for Akpoti jus dey look them dey jot their names down.
11. One if the people wey dey drag God still put " Blood of Jesus " poster for house. As we see say she go be hard man online still go pray morning devotion 5am.
12. Rape Apologist full this app as Blocking ministry start as no time to dey follow mumu dey talk too much.
13. One Monkey don japa with COVID-19 samples' as the monkey turn Mike Tyson rush the lab assistant wey block him way with multiple blow for mouth.
14. Nigeria’s COVID-19 cases don dey rise like ijebu Garri as we know no who dey add water to the Garri anymore sake of say we still dey inside house.
15. 53 YEARS OF BIAFRA, as Ndi Igbos remembers the labour of our heroes past, never may we forget.
16. John 'babayaga' Wike don set fresh lockdown as PH say dem get coconut head and no dey hear word, him wan show dem say him head big pass
17. Lai Mohammed knack us another ogbonge Lie again as e say make we dey Expect 11,000MW of electricity by 2023.. Just better go buy Gen.
18. Regina daniels don carry belle as we see say Old soldier can never die, as our Oga Ned ' Van Persie' Nwoko no dey shoot blanks.. Better striker e no even reach 1 year.. Boom! Baba don score goal. Make d pikin no resemble the man sha.
19. Peter Obi say na the borrow borrow wey FG dey like boroow untop make dem see food chop, na him go kill all of us as na better corruption be that
20. Oga Bubu say na close to $1bn na him Abacha thief stolen as we dey wait update for the last money wey dem collect from Abacha.
21. Nigerians begin mark scores for Buhari's first year into 2nd term, as we see say carryover plenty as e go rewrite plenty course and e no go EVER graduate.
22. Presidency still insist say Nigeria of Now better pass before, As dem no gree say den get carryover.
23. All the Fresh fresh loans wey Nigeria don collect, e no go too tey dem go auction Nigeria for highest bidder.-PDP.
24. Na so so Mouth USA dey make as we still never recieve even one ventilator from them untop COVID-19:
25. BBNaija Pepper Dem Reunion go start today as e better make u Mute Tacha and Mercy cause the Nonsense go reach ome full week.
26. Cynthia Morgan swallow Frog as she say make we forgive am say she make mistake.. Make she first go beg Jude Engees first make we start from there.
27. Slim Case show say e be bastard as him say and i quote " Let channels report the news of the girl " and people for instagram dey comment love and light
28. As Twitter call am out with Anthony Joshua right hand punches for him mouth, him come day say e no know make we no vex
29. Dice Ailes wey dey sing music, come talk him own too as e say and i quote " DO I LOOK LIKE I AM NIGERIAN" sake of say person tell am to use him platform report local issues other than George floyd na so e reject 9ja. Well, Him music no go sell pass how e don sell, Amen.
30. Huge W as Apple Music don announce DJ Cuppy as its first radio show host in Africa. As the fine girl jus dey happy like 4 yrs old wey dem give sweet lick.
31. Shenghai Shenhua don offer Ighalo to Man Utd until Jan, as Man Utd fans don gather money to celebrate this huge W.
32. Inter say dem wan keep Sanchez small make e still dey play for them as Man utd fans throw party say dem no want Piano Man.
33. Lewandowski knack brace as Jadon Sancho Waya him first Hat trick as Dortmund still dey pursue Bayern for back.
34. Tot say if Kane commot, dem go carry Victor ' Cristiano' Osimhen' as Chelshit say dem use one corner of eye dey watch Samuel 'Lionel' Chukwueze.
35. Madrid, Assnal, Chelshit don line up for Wilfred 'Makelele' Ndidi house. As we dey wait for highest bidder na so Assnal logout
Weekend was mad!!!

Don't forget.. Join the protest in Benin and Abeokuta!

Join from your work place.. Homes.. Raise a placard with the hashtag..

God bless. We pray for a better month.
You can follow @Nsukka_okpa.
Tip: mention @twtextapp on a Twitter thread with the keyword “unroll” to get a link to it.

Latest Threads Unrolled: