#EidMubarak Twitter NG.
You no come online yesterday?
Oya take Summary #Okpayarns
1. Cynthia Morgan don clear us say na frustration dey play Tinko Tinko for her neck na why her voice don cold
2. She dey IG Live dey explain how kasala burst for head na why she run since 2017
3. Cynthia Morgan say the contract wey she sign with Jude FC, don begin tidy her as she dey swim inside River Debts and Team Manager Jude Mourinho Engees no wan let her go as him seize her name join.
4. The money wey Cynthia Morgan dey owe reach 40 million, money wey go buy Benue state 3 times remain change.. Na so some Good Samaritans create GofundMe account to help raise the money.
5. Contributions begin go round as some bad belle begin talk say make we no help am.
6. Make we for no loss, Twitter NG come out in full force to help her rise like ijebu Garri, as she begin trend.
7. Her Ex Boyfriend, Agege Giant' Burna Boy no chuke mouth for the matter at all but if na to argue against Davido and Wizkid na there e go turn Hulk Hogan.
8. E no too tey, Davido Odogwu 1, come hear the cry of Twitter NG as dem don tag am plenty for the Cynthia Morgan issue na so him say, make she call am.
9. Davido still add say e get Better Gbedu wey go Lucozade boost her career back to where e dey before.
10. Bitter leaf Twitter begin vex say why Davido tell her to call am in public.. Why e no call am privately if e wan help am. Like say if them give 1k for church offering everybody for church no go know.
11. Peter 'Psquare come out to say when e dey talk say Jude Mourinho Engees Na bad coach, nobody believe am, say shebi we see wetin e don do Cynthia Morgan.
12. Peter still send a Love and light give Cynthia Morgan as if na wetin she go carru chop be that.
13. May D come out to come say even when him dey play Striker for Jude FC, him no see food chop, and as e dey sing chop my money, e no even get money to chop.
14. May D say e dey sleep untop Carton, on a daily as per The manager and team members no gree am sleep for bed.
15. This things wey dem dey talk come Mad Jude Engees as dem dey spoil him Club name, baba come vex go IG live with Tunde Ednut.
16. Tunde Ednut jus dey waste our time dey ask Family issues, as dem first block Blaqbonez untop say e dey advertise him Music. Stream Haba sha!
17. The Koko from the IG live be say, Jude deny every yama yama against him club as him say Cynthia Morgan dey Lie, say how e go seize her name and she dey free since 2017 as per she no be Kunta Kinte.
18. Jude say him go drop reciepts after the call end.
19. Him also add small Okporoko as him say May D matter na normal business as per dem don spend $100k untop him head and psquare coming back no be him problem.
20. Twitter NG confuse on who to blame as we dey wait Sherlock Holmes and the scooby Doo gang to come solve this case
21. Fine fine girls and guys begin drop picture untop Eid celebration, as we see Say Arewa community dey swim inside money.
22. People wey been dey slander Arewa people before, begin lick mouth dey find way to give them belle.
23. NCDC drop scores, but as usual, person no fit die two times. Operation All die na Die continues..
24. Nigerian soldiers don Kolobi 35 Boko faithful, seize their weapons and still seize their food stuff join. Now Boko haram no go see food chop, Kwashiorkor go kill dem.
25. Dem give Buhari chair during Eid prayers, as IPOB members start another Conspiracy again.
26. Doctors, Nurses show El Rufai say dem get coconut head and dem no dey hear word as dem start strike for kaduna.
27. Eight days after, Presidency never still send The Madagascar Agbo to Nafdac make dem test am, e be like dem don drink am carry am chop bread.
28. June 8, Universities go resume, as serious student don dey prepare to come back, Marlians still dey ask " How True is this News?
29. NYSC batch A don recieve another 33k for doing absolutely Nothing as dem begin rejoice everywhere. Jus hope say money go remain for Batch B.
30. SERAP don come out to carry John 'Babayaga' Wike to Ecowas Court as dem label the man Rascal untop say him Kpokpo their building.
31. Buhari don appoints Ebonyi REC Obioma as the new NECO registrar maybe Now, Neco exams go dey Easy to pass.
32. Some Bitter Leaf Igbos come dey swear for am say why e no appoint dem as Chief of staff or any other Ogbonge position. Why na Neco.
33. Police don kidnap the kidnapper wey kidnap the catholic priest for Imo state, as dem arrest am come rescue the priest.
34. Pochettino dey jollificate say him run leave the work for Mourinho to suffer am finish for Tottenham.
35. Sodje say na Babayaro be the greatest Nigerian to play for Epl because Kanu and Mikel dey sell Sell groundnut for ketu Mile 12.
36. FG still dey confused over management of the Chinese COVID-19 medical team led by Won Fei Hung and IP man as people dey ask where dem dey.
This should be all from the weekend.

I'm posting this now cause my phone won't be available tomorrow..
Retweet and tag ur friends.
You can follow @Nsukka_okpa.
Tip: mention @twtextapp on a Twitter thread with the keyword “unroll” to get a link to it.

Latest Threads Unrolled: